Ghana Accra agenda for 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments

Wia dis foto come from, Ghana Presidency
59th Ordinary Session of di ECOWAS Authority of Heads of State and Government hold on Saturday inside Accra, Ghana.
Dis meeting na follow up to di February 2021 extra ordinary summit of di Economic Community of West African States [Ecowas].
Na during dis meeting dem go adopt some of di reports wey dem don receieve since February as e concern dis operations.
Nigerian leaders, President Muhammadu Buhari and former president Goodluck Jonathan don land for Accra, for di ECOWAS meeting.
Dem join oda West Africa leaders wey dey attend di regional block summit wey President Nana Akufo-Addo of Ghana dey host.
Wia dis foto come from, Ghana Presidency
President Akufo-Addo tell oda west African leaders wey show face on Saturday say dem go enta closed door to discuss di following:

  • African Continental Free Trade Area (AfCFTA)
  • Eco – West African single Currency
  • Rotation of leadership inside di region and continent
  • Security challenges and terror attacks for West Africa
  • Sea Piracy – Operational maritime centers wey go battle dis concern
  • Strength of di regional block

Before dis 19 June Ecowas summit, di west African regional power house bin hold emergency meeting on Sunday May 30 2021.
Di one-day meeting for Accra bin discuss di situation for Mali wia di coup leader dia Col Assimi Goïta declare imself president on 24 May.
Ghana President wey also be di Chairman of ECOWAS, na im call for member head of states to come discuss Mali mata.
During dis 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments former Nigerian president Goodluck Jonathan go present report.
Jonathan na im be di Ecowas special rep alias envoy ontop Mali go brief di west African leaders on di double coup inside Mali.
Wia dis foto come from, Ghana Presidency
Host Ghana also dey expect say dem go use dis meeting address di need to review Africa position for di UN Security Council.
President Akufo-Addo wey yan dis one during di opening ceremony on Saturday also hail some west African kontris.
E commend dem for dia successful conduct of elections and change of political leadership recently inside dia nations.
Nigeria bin don condemn di 24 May coup, plus how soldiers come later detain Mali president and prime minister.
Louise Mushikiwabo, di secretary general of La Francophonie also address di event as special guest wey di Ecowas chairman invite.