Di Governor say unknown gunmen wey reach about fifteen all dressed in black bin dey shoot directly at him and e security men.

Wia dis foto come from, Getty Images
Benue State governor for central Nigeria don confirm say true true gunmen attack am on Saturday, 20 March.
Di Governor say unknown gunmen wey reach about fifteen all dressed in black bin dey shoot directly at him and e security men.
Im allege say di attack bin dey planned to “eliminate am, as im run for about two kilometers.”
Wetin we call dis Video, Governor Samuel Ortom say ‘government suppose give bandits same treatment as ESN, IPOB’
Di incident according to di govnor happun along Makurdi/Gboko road for Makurdi Local Government Area of di state .
Ortom, wey bin address journalist afta di incident describe di gunmen as ‘herdsmen’, im say na about 15 of di attackers trail am to di river bank wia im bin dey on foot.
Governor Ortom na one pesin wey bin don speak out against di actions of alleged herdsmen wey don cause insecurity for Nigeria in recent times.
Di governor for exclusive interview wit BBC News Pidgin for early Marcch say im know say di group dey illegal and im no support dia activities.
Im also call for Nigeria goment to treat di herdsmen di same way wey dem treat di Indigenous People of Biafra and dia Eastern Security Network paramilitary wey dem proscribe.